LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Two girls wey dey related don die after thunder strike dem for Ikirun, Ifelodun LGA, Osun State.
Dis one been happen for Ogo-Oluwa area of Orisa Elejin community around 4:30PM on Sunday, August 29th, 2021.
A resident, Mary Ojuolape, been tell di Nation say di young girls been dey cross one field for di area as rain dey fall before di thunder strike dem.
Another resident, Dayo, talk say plenty people gather around di bodies of di girls.
Di chairman of di Ifelodun LGA, Hassan Okanlawon, confirm say dem see di girls body for di ground of one Arabic school after di lightening strike. He talk say di grandma been don send dem to buy ingredients for evening food before dis one happen.
Dis na how di LGA chair talk am:
Thunder don strike 550 sheeps for on top mountain
“On their way, lightning struck them and they both died on the spot. They were living with their grandmother. One of them was from Delta State and the other, Ondo State. I was told that we could not immediately remove their bodies. They said Sango adherents must perform some rites. I was informed that some Sango worshippers from Ede were on their way to the scene.”