LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One senior man for di Japanese Yakuza criminal group don collect death sentence by hanging.
A court for Fukuoka been find out say Satoru Nomura, 74 years, di oga kpatakpata of di Kudo-kai for Kiya-Kyushu, Fukuoka Prefecture, been don order 4 assaults and one been lead to death. Nomura talk say he no get any hand for di matter.
Di Asahi Shimbun newspaper report say di Judge Ben Adachi been follow sentence Nomura second – in-command, Fumio Tanoue, 65 years to life imprisonment.
Nomura been don threaten Judge say he go regret am and dis na how he talk am:
“I asked for a fair decision but this is not fair at all. You will regret this for the rest of your life.”
See photo:
Nigerian man don collect death sentence after he kill nurse for Malaysia
Di defence been don argue say Nomura been dey innocent for all di 4 cases and di Japanese don plan to appeal against di sentence.
Yakuza membership no dey illegal for Japan and dem dey take time mark di Yakuza-owned businesses and gang headquarters.