LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
ICPC don carry di Dean and Director of General Studies go Cross River State High Court 6, over her alleged involvement for contract fraud of N20.6 million.
Di agency been accuse Prof. Bassey wey be di University Director of General Studies and former Director of Pre-director say she don carry over 4 contracts wey school give out, give to her own companies.
ATTEMPTED FRAUD: This man go wash toilet for Abuja motor park for 60 days
According to wetin ICPC talk for di 10 counts wey dem file before Justice Elias O. Abua on Wednesday, August 18th, dis thing been happen between 2013 and 2017 and e violate Section 12 of di Corrupt Practices and other Related Offences Act, 2000.
Prof. Bassey been don benefit over N20,679,324.63 from contracts wey she carry give her own companies, Bakuf Ventures, Rivet Investment Nigeria, Ltd, Joebs Enterprises and Arumo Nigeria Ltd.
Di accused been don plead not-guilty after dem read di charges give her. Her lawyer, Barr. Joseph Oloku, been don file bail application make di court grant her bail on self-recognizance.
EFCC don arrest 10 suspected Internet Fraudsters for Kaduna (photos)
Justice Elias O. Abua been don grant her bail of 5 million with one surety in sum, and di surety gats get landed property within di court jurisdiction. Di matter dey adjourned till October 11 and 12 for trial.