LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di Hisbah Commission for the promotion of Islamic Teachings for Kano state don finally chuk mouth on top wetin Zahra Nasir Bayero, daughter of Emir of Bichi been wear for her bridal shower.
Zahra Nasir go soon marry President Muhammadu Buhari son, Yusuf.
For her bridal shower, she been wear one gum body white lace wey even dey transparent for di shoulder and hand. She been no even cover her head so everybody come dey ask why morality police for Northern Nigeria never talk any thing on top wetin she wear but if to say na poor Muslims, dem for don punish them.
Nigerians talk say Hisbah dey ‘biased’ in favor of di children of rich Muslims dem.
See di wedding of 50-year-old mama of 3 boys
Hisbah commander, Sheikh Harun Ibn Sina been tell BBC say sultan daughter no big pass di law but she gats lead by example if she she want blessing for her marriage.
The sheikh talk say na crime for people to kdey share di pictures everywhere.