LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di family of Ubong Friday dey call for justice after dey don finally discover di corpse of di deceased from river for Rivers State.
Friday been drown for swamp as he dey try escape arrest by di police for Rumuigbo, Obio /Akpor LGA, Rivers State on Monday, August 2nd, 2021.
Di artisan been dey work for construction site for Rumuigbo when one person wey dey live for di area been call police make dem come arrest di site workers say dem don use sand block him frontage.
Site worker don die as he dey try escape police arrest for Port Harcourt
Ubong brother, Joseph Etim, been confirm say police been go find di corpse go put am for mortuary for University of Port Harcourt Teaching Hospital.
Etim talk say na Police do make him brother die. This na wetin he talk:
“The Divisional Police Officer sent her men to bring the corpse from where it was recovered. I want justice so that the issue will not be swept under the carpet like it is normally done when police personnel kill innocent people.
The police are not saying anything other than recovering the body and depositing it in the UPTH morgue.”
Di spokesman for di state police command, Nnamdi Omoni, been tell Punch say police no get hand for di death say na to just come see wetin dey sup when person call dem.
See how he talk am:
“They were trying to clear the place that was blocked and our men were invited. It wasn’t as if the police were chasing him (Ubong); when our men advanced to the place, the workers all ran.
He (the artisan) tried to scale a fence and landed in a pit and got stuck. What I’m telling you is what the DPO told me.”