LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di son of di General Overseer of Word Bank Assembly don reveal say he been no know say him papa don marry until he see pictures online.
Pastor Adesoji Adeeyo, di son of pastor Moses Adeeyo, don talk how him mama been suffer with him papa to build di church from scratch before him papa serve her divorce papers last year comot her load from di house.
Peter wey be 31-year-old pastor talk say, him mama been come squat for him house before she come go Abuja to live with her sister and na deir she still dey like this.
Peter talk say he no sabi Tina Adeeyo, him papa wife and he never take eye see her before. He say he shock well well after him friends been tell am on Sunday follow show am pictures.
Peter talk say him papa and mama never divorce officially as di case dey for court.
See di Facebook video here:
Di woman wey leave her husband go marry her pastor don chuk mouth for di matter