LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Tina Adeeyo, di woman wey been leave her husband of 11 years don follow chuk mouth for di matter after her ex-husband bring their matter come social media. Bright been talk say hi wife run comot for house go marry their pastor and di pastor say na cause of holy spirit.
Tina talk say she don dey suffer abuse and threats to life all through her marriage to di man, Bright Ben. She say she just endure make she see if her marriage fit work.
She say she don run go her papa house for PH plenty times but later she go just go back to di Bright man. She say she don borrow plenty money because of Bright make dem take hold body so they di debt don choke her.
She talk say Bright been do make she swear say she no go ever leave am go another man and because say she love am, she swear for am. She talk say he don threaten to put acid for her cream and her children don dey pity her into everything she don pass through.
Tina talk say God don give her life, rescue her from lion wey been wan devour her and even Tina mama don chuk mouth for di matter.
Watch di video for here:
Pastor don marry person wife of 12 years, talk say na holy spirit tell am