LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Dey don detain one Senegalese student after he dress like woman to go write Nation examination give him girlfriend.
Di student wey dey for university for di country Northern region and him girlfriend been dey under arrest on Monday evening.
Even tho dey never disclose him age, he been don move from Diourbel Tao come write di exam for him girlfriend wey dey secondary school according to the prosecution.
One man don die as he dey try escape police arrest for Port Harcourt
Pictures wey dey post for social media show say he dey wear red dress with black patterns and veil wey get the same color make he fit trick invigilators. Local media talk say invigilators been catch am on di 3rd day of di exam after dem see say something no stand well for him cloth, so dem call police.
Their lawyer, Serigne Ndiongue confirm say di court go try di man and him girlfriend for “exam fraud” on Thursday, August 5th, 2021.