LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Dey don name Afghan baby wey born for inside US military plane on di way to Germany, Reach, di aircraft code name.
Di baby mama been don enter labour on saturday as dem been dey fly from staging base inside Qatar to Ramstein Air Base. Just as di plane been land, military doctors been help di woman born her baby for di cargo hold of di plane.
Di code for C-17 cargo planes na always ‘Reach’ before di number.
According to tweets from di US Air Mobility Command, di mama been start to get complications after she enter labour so di aircraft commander been bring di plane come down small make pressure increase to save her and di baby.
When di flight been land, di doctor people from di 86th medical group been come put hand make dem born Reach before dey carry dem go hospital.
Reach and her parents go soon relocate go United States of America.
Of di 7,000 people wey dem don evacuate from Kabul wey don pass through US bases for Europe since August 20th, only 100 been require medical care. Among di 100 Afghans, 25 don dey admitted to local hospital and dem don discharge 12.
Dem been born 2 oda babies after deir mama land for di Ramstein base.