LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Di South African Police (SAPS) for Mpumalanga don tell parents make dem no dey lock deir children put for house alone.
Dis oone dey come after two small children wey dem lock inside house been die for fire on Monday for Amerfoort.
SAPS Mpumalanga spokesperson, Colonel Donald Mdhuli, wey been confirm dis one for statement on Tuesday, August 17th,talk say di small pikin dem na twins, boy and girl and dem be 2 years old and another girl wey be deir cousin. He talk say di mama and papa been leave dem for house help hand and di house help come leave dem make to go buy something for shop and with candle wey dey burn for inside house as light been no dey.
Neighbors been come see fire so dem rush to help and di house help come talk say di children dey for inside di house. Dem been rescue di boy, but di two girls been don die already. Di boy dey collect treatment for hospital like this.
See di pictures here:
[Photos] More than 200 people don die after 7.2-magnitude earthquake strike Haiti