LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
A 15-year-old girl don die while she dey have sex for inside car with a 26-year-old man.
Even though police still dey wait for post-mortem, dem dey suspect say she die of heart attack.
Gabrielle Dickson Alves Nascimento been faint while she dey have sex with one man on Thursday, July 29th so he rush her go hospital.
See di pictures of di new corp members wey die for road accident as dem dey go Katsina from Uyo
Di man tell police say he been dey have sex with her before her lips and skin turn pale and her hand bend go back.
Doctors for di UPA Jardim Casquiero medical facility for Cubatao, Sao Paulo, talk say na cardiopulmonary arrest but dem no fit save Dickson, so she die di next day for early morning of July 30th, 2021.
For di first test wey dem do, dem been see blood for di girl vagina, but nothing else wey fit make am be like say person assault her.
The older man, wey be “general services assistant” never get any charge for crime as di age wey person fit accept make sex happen for Brazil na 14-years.
One man don die as he dey try escape police arrest for Port Harcourt
Dickson friends and classmates talk say she be hard-working, dedicated and happy person plus everybody love her.
Di final post wey she write for Twitter just 2 days before she die na: “Who is it that hates me?