LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
The WHO don talk say over 100k people fit die after Tokyo Olympics finish due to Covid-19. The Tokyo 2020 summer Olympics been don delay because of the Covid-19 pandemic and e son finally start today, Wednesday, July 21st 2021.
Over 11,000 athletes from 200 countries go come for the Olympics and over 79 people don already get Corona virus. 5 people wey get an na Olympic village residents, 3 na athletes like US gymnast Kara Eaker, basketball player Katie Lou Samuelson and Coco Gauff wey been just get am as dem come Tokyo and now dem no go fit continue for the game.
WHO Director-General, Tedros Adhanom Ghebreyesus don tell people make dem no forget say Covid-19 still dey for the world and e fit spread very fast. Na like this he talk am:
“By the time the Olympic flame is extinguished on the eighth of August, more than 100,000 more people will perish,” Tedros, who is in Tokyo for the Games, said on Wednesday.
The pandemic is a test, and the world is failing,” he said, adding that anyone who thinks the pandemic is over is living in a fool’s paradise.”
All this talk dey come as cases don dey grow for the whole world including Japan. Plenty people been no want make the game hold for inside the Covid-19 pandemic and even International Olympic Committee (IOC) no gree make people come watch and na the first time this one dey happen.