LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Trial of Uduak Akpan, the alleged murderer of Akwa Ibom jobseeker, Iniubong Ephraim Umoren been face trial for Akwa Ibom State High Court 6 for Uyo today, Monday, July 26th, 2021.
According to statement wey media unit of Akwa Ibom State Ministry of Justice release through the information officer, Effiong Edet, the state’s Attorney-General and commissioner for Justice, Uko Essien Udom na lead counsel for the prosecution team.
Iniubong Umoren, wey be final year student of the department of philosophy, University of Uyo, from Oruk Anam LGA been dey find work to take hold body only for dem to call police say Uduak Frank Akpan don kill am.
Police been don go collect her body wey he bury for shallow grave. Her body been dey like he squeeze her neck and her eyes and tongue dey outside. Police been don forward this case go Department of Public Prosecutions (DPP), but dem been no fit do anything as Judiciary Staff Union of Nigeria (JUSUN), been don suspend Industrial action.
Today for Court, Uduak been plead guilty to killing Iniubong as no lawyer gree represent am for court.