LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Blessing Okagbare, the only hope for Nigeria to get gold medal for the ongoing Tokyo Olympics no go continue again as she don fail her drug test. This na di first case of drug test failure for the current Tokyo games according to officials.
The Athletics Integrity Unit for their statement talk say Okagbare wey been win di opening of women’s 100 metres race for Friday, don test positive for human growth hormone.
Blessing Okagbare dey lead di women’s 100m for Tokyo
This test been take place on July 19th, according to the AIU and the results comot early on Saturday.
This na di latest gbas gbos for Naija track and field campaign for Tokyo Olympics. For Thursday, the AIU been talk say 10 out of 18 Naija athletes no go fit compete as dem no reach di requirements for out-of-competition testing.