LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
The 6th season of the big brother reality show wey be “shine ya eye” don land.
The show get 22 housemates and 11 na females don land today 25th July, 2021.
Biggie don talk say e get 2 wild cards wey dey the house and if other housemates no fit find dem, dem go remain for there.
The housemates go win N90m worth of prizes.
Oya make we meet the female housemates :
Angel

Her full name na Angel Agnes Smith and she be proud feminist. She be drama queen and na 21-years old. She believe say big brother go help her start her journey for writing and cinematography.
Arin

Arin na 29-year-old feminist wey grow up for polygamous home for Lagos. She be fashion designer and she get 17 piercings for her body.
Beatrice

Beatrice na 28-year-old fashion model and upcoming actress. She follow get one boy wey be 5-years-old. She r graduate from University of Port Harcourt where she been study marketing. She fit sing, dance, play ball and do hair. She dey do software development too.
Jackie B
Jackie B na proud single mum and hardworker. She be interior designer and certified event and wedding planner. She been school for UK where she been born her son. The 29-year-old fit enjoy body well well and to dey with people wey she love dey sweet her body. She talk say she be “introverted extrovert”.
Liquorose
Liquorose name na Roseline Omokhoa Afije. The 26-year-old been dey do video vixen work before she come dey dance as na wetin dey sweet her pass be that.
Maria
Maria na 29-year-old former air hostess. She dey like cook, exercise, hike, act and dance. She talk say she dey loving and kind hearted and she dey like new adventures. She talk say she don go around the whole world except Antarctica.
Nini
27-year-old Nini na economist and fashion entrepreneur wey dem born, raise for Nigeria. She get four siblings and better mama wey she too love. She dey live for Abuja and na University of Abuja she graduate from.
Peace
Peace na 26-year-old entrepreneur for Port Harcourt. She too like cloth and shakara so she don open her own clothing store.
Princess
Princess na 30-year-old e-hailing service driver and business owner. She dey base for Abuja but na from Imo state. She talk say one thing wey she like well well na when she buy her first car and the one wey break her heart well well na when her papa die.
Saskay
Saskay full name na Tsakute Jonah. She be 22-year-old lover of books and extrovert. Even tho dem been suspend am for school for 2015,Saskay don win titles like “model of the year” and “Female personality of the year” for her university.
Tega
Tega na 29-year-old mama of one child. She business owner wey dey like dance, travel, DIY and photography. She talk say she dey like learn and she dey use difficult times take learn follow grow.