LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
One man wey dey pretend say him head no correct don collect better beating from the residents of Owode LGA for Ogun State after dey catch am with N250, 000, 3 iPhones and women underwear.
The residents been see the man wey been dey stay under the bridge for Mowe, Obafemi Owode LGA for Ogun State as he de answer call on Thursday, July 29th, 2021 before dem confuse go approach am.
According to Punch, the locals been ask am where he carry phone from but he no fit answer, he even dey try to run. The locals been catch am, search him clothes come find N250, 000, three iPhones and women underwear before dey give am better beating.
See the Bauchi Poly students wey dey use streetlight read for exam: See full gist
One Ade wey take eye see everything wey happen tell Punch say him and him friends been dey play bet when dem see the mad man on phone so, them go ask am where he take phone and who he dey talk to before he start to run.
This na wetin one trader, Yetunde talk:
“When he was asked who he was talking to, he refused to talk; it was the annoyance that made people to start beating him and wondering where a lunatic got such amount of money, phones and women pants and bra from. This is an eye-opener to everyone in Mowe. Only God knows how many atrocities he has committed in Mowe.
Probably he is working with ritualists, because I don’t know where he got the money and the phones, and maybe the underwear belong to women he raped or killed and sold their body parts.”