LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Police people for Lamu, Kenya don arrest one 35-year-old man wey been dey wear woman cloth for Bajuri area, Lamu Island. The man name na Mutahi Wahome and him been dey wear Bubu come carry hand bag join when police catch am for Saturday night, July 17th 2021. Na pink dress, bra and pant he wear for under the bubu as per wetin Police talk.
As police ask am wetin do make he dey waka for night after dey don tok make everybody dey for house, Wahome tell Police say he been dey work on a pair of wings as he dey try to dey fly. He tok say he go dey fly from earth dey go other planets dem once he fit complete him work.
Wahome follow tok say he fit help people wey dey build plane well well and he don dey try to collect permit make he fit dey fly for the country airspace.
Police don ask am why he wan test him wings for 1AM, beach area and he tok say nothing fit disturb am for deir as people no dey that time and the plenty air dey help him work. Na like this he tok am:
“I don’t want to cause an accident. That’s why I do it when there are no people, plus at the beach there is wind which helps me test the acceleration powers of my wings. Just like with any other invention, you don’t test where there are people unless you are confident about it,”
The police officers tok say dem been dey do their work before dem come see Wahome and as dey tell am make he stop he come dey run. This na wetin dem tok:
“We knew a woman couldn’t run at such a high speed at such a time and so we pursued him. We were shocked that he was actually a man dressed like a woman”
Wahome tok say person fit don curse am as he don dey wear woman cloth since 9 years. Wahome been leave Nyeri county come Lamu last year and he dey learn work for one carpenter shop and na for their he dey do him invention too.