LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Wahala been burst as dem tell the woman wey dey dance for music video Bolanle to comot her husband house. E never reach six months wey she marry her husband. Many of una go sabi Bolanle for the music video wey she dance for Zlatan Ibile wey been make wave.

The couple wey be say dem don already born one pikin been get some issues wey later turn to kasala.
The hubby, Abiodun Lincoln, talk say Bolanle been dey fight well well, come dey spoil thing everywhere. He even talk say the child wey she get for him na for clout.
He also post video of the things wey dey for house he talk say she spoil.
He also come dey point finger for Bolanle and her family. He talk say she born her pikin for clout.