LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
For Tongan beach, cocaine wey fit sell reach $1 million don wash comot for water as police been dey find something like that for other water dem on Thursday?
People wey dey live for Pacific nation’s northern Vava’u group of islands been find the package take am give officials.
Acting deputy police commissioner, Halatoa Taufa talk say Police been dey join hand with Navy to look the water and dem get info say something like that go dey water.
This na wetin Taufa talk:
See di man wey try to stab Mali president for inside mosque: Full gist here
“There is a possibility that more packages may turn up on the beach and we ask any members of the public to immediately contact police if they found or knew anyone to have found further drugs.”
Taufa talk say the package resemble the ones wey dem don discover before. For 2012 for inside one yatch JeReVe, police been discover Cocaine wey fit sell for up to $120 million.
For 2017, French Navy been catch yatch wey been dey carry cocaine wey fit sell for up to $100 million near Tongan water. The next year 2018, Police been find cocaine wey fit sell for up to $13 million after e don wash comot for water.
Tonga don dey get bad luck for where e dey according to United Nations Office on Drugs and Crime as na their water road drug manufacturers dey take reach their big markets for Australia and New Zealand.