LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
FBI don arrest 3 Nigerians wey don commit fraud for United States of America. Security cameras wey dey for Automated Teller Machines (ATM) been snap the face of the Nigerian youths wey thief over $ 1.4 million (about N580 million) jobless benefits from California, Arizona, North Carolina and Maryland.
The people wey do this thing na Quazeem Owolabi Adeyinka, 20 years, Ayodeji Jonathan Sangode, 22 years and Olamide Yusuf Bakare.
Court don sentence man to wash toilet for 60 days for attempted fraud : Full gist here
U. S. authorities been catch them last week talk say dem thief over $ 2.6 million for bogus unemployment insurance claims. The suspected crooks use address Hyattsville, Maryland take thief about $ 1.4 million for unemployment benefits. At least $ 1.2 million wey dey thief na from California alone.
Three of them been file over 200 unemployment claims for California Employment Development Department and dem talk say their address na 75th Avenue for Hyattsville and the EDD sef no sabi dem carry 97 people share give dem according to wetin John C. Collins, special agent for U. S. Department of Labour talk.
Mr Collins talk say FBI, Department of labour’s office of Inspector General and state law enforcement authorities follow put eye for the matter. Na so so lie the boys dey tell for their applications.
Pictures for here: