LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING
CLICK HERE
Ankara na one popular wrapper wey plenti Africans dey like to sow as cloth and some people just dey tie am for waist wear shirt for body on top some cultures.
Plenty pipo dey call am wax, aso-ebi and na wetin dey reign for Nigeria and plenty places for the world. Old people dey rush am and young people sef no dey carry last.
This material sha get plenty kinds, e fit be Ghana wax, English wax, vlisco ankara wax, Dutch wax, woodin print, uniwax and other kind ones. Now sef, na wetin everybody dey wear go show body for wedding be dis.
We don dey see say people dey use the material take sow different casual styles like suit, shorts and all that kind oyinbo styles dem.
You fit even sow ankara material join am with lace, chiffon or another better combo and e go still de kampe.
Pencil trousers/ designer suit
Ankara na material wey you fit sow anyhow wey you like, e fine, get plenty design, come even sweet for body, style no de ever finish for am at all.
Pencil gown with side slit
If you been de find ogbonge Ankara style wey you wan sow give your self or your friend just carry one for here dey go.
You get any other styles wey fine? Tell us for comment section. For now, see this ones them.