• About
  • Contact
  • Privacy Policy
No Result
View All Result
  • Login
Amebo Update
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija
No Result
View All Result
Amebo Update
No Result
View All Result
Home News

Senate presido break silence on Twitter ban

Nigerian Senate presido Ahmed Lawan don tok say Naija people need twitter and e no go well say government ban di bird app for di contri

by Pidgin Parrot
June 26, 2022
Reading Time: 3 mins read
0
Senate presido break silence on Twitter ban
327
SHARES
2.5k
VIEWS
Share on FacebookShare on Twitter

LEARN TO MAKE MONEY WITH AFFILIATE MARKETING

CLICK HERE

Senate presido break silence on Twitter ban

As him follow journalists tok for National Assembly inside Abuja on Friday, Lawan say di country pipo need Twitter as e be say na part of wetin dey help keep up with wetin dey happen for di world.

Di oga of di national assembly say dem dey hope say federal goment and Twitter go try settle di kwata wey dem get.

APC NATIONAL CHAIRMAN, DEPUTY DON RESIGN FROM SENATE

Di whole palava start wen twitter delete one tweet wey di handle of di nigerian presido make. Di tweet no too go well and people begin call on twitter to delete wey dem finally comt. E no tey after twitter delete di tweet, FG suspend dia operation for di country.

As Ahmed Lawan take tok am;

“The honorable minister of information, Alhaji Lai Mohammed, informed Nigerians that they are talking with Twitter to resolve this matter. Our belief is that Nigeria needs Twitter just as much as Twitter needs Nigeria, we believe that the matter between Twitter and the federal government of Nigeria will be resolved but beyond that, I’m an optimist, I believe all of us will have learnt our lessons.”

Who be Ahmed Lawan?

Ahmad Ibrahim Lawan na Naija politician and professor wey dem born on 12 January 1959 and e don serve as the Senate President of Nigeria.

He finish him primary school for Sabon Gari Primary School, Gashua in 1974 and secondary school for Government Secondary School, Gashua in 1979 before he collect bachelor degree in Geography from the University of Maiduguri in 1984.

After university, Lawan do himyouth service for Benue State before he later go collect master degree in Remote Sensing from Ahmadu Bello University plus Doctorate degree in Remote Sensing/GIS from Cranfield University in 1990 and 1996.

He dey represents di Yobe North Senatorial District for Senate and na member of the All Progressives Congress. Lawan first enter di House of Representatives in 1999 as university lecturer from Gashua to represent di Bade/Jakusko Constituency as member of All Nigeria Peoples Party.

Lawan been work for Yobe State Civil Service as Education Officer for di state Ministry of Education in 1985 and 1986 before him go lecture for him alma mater, University of Maiduguri between 1987 and 1997.

As ususal with many of di Naija goment officials, after dem pass di Petroleum Industry Bill (PIB) for August 2021, dem accuse Lawan and other legislators say dem collect bribe to make sure say di legislation move forward even though say dem no get public support for some parts of di text.

According to wetin Peoples Gazette report, di legislators collect at least $10 million bribe from di Minister of State for Petroleum Resources Timipre Sylva and Akwa Ibom North-East Senator Bassey Albert Akpan. Lawan and House Speaker Femi Gbajabiamila collect around $1.5 million and $2 million.

Many legislators confirm di story as many of dem dey vex say Lawan and Gbajabiamila no share di money well. Other legislators say na around $5,000 dem collect as representatives and $20,000 as senators.

At first, Gbajabiamila, Lawan, Sylva, and Akpan been no wan talk about  di mata but after some day wey di mata cast, Lawan deny am with big grammar as e say

‘the report is “unwarranted, unproven, and false”

 

 

Tags: NaijaSenateTwitter ban
Next Post

Olamide Ft Fave – Ponpon

Pidgin Parrot

Pidgin Parrot

Next Post
Olamide - Ponpon Ft. Fave

Olamide Ft Fave - Ponpon

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No Result
View All Result

Categories

  • BBNaija (31)
  • Celebrity (235)
  • Culture (9)
  • Fashion (2)
  • Food (1)
  • Health (20)
  • Lifestyle (67)
  • Music (26)
  • News (612)
  • Travel (25)
  • Uncategorized (20)

Recent.

Full Winners List: BET Awards 2022

Full Winners List: BET Awards 2022

June 27, 2022
FULL GIST: Burna Boy And Cubana Shootout

FULL GIST: Burna Boy And Cubana Shootout

June 12, 2022
Make Una No Dey Use My Song – Timi Dakolo To APC Pipo

Make Una No Dey Use My Song – Timi Dakolo To APC Pipo

June 11, 2022

For all the better totori wey dey we entertainment, music and other gbedu wey dey burst brain.

  • About
  • Contact
  • Privacy Policy

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

No Result
View All Result
  • Home
    • Home – Layout 1
    • Home – Layout 2
    • Home – Layout 3
    • Home – Layout 4
    • Home – Layout 5
  • Fashion
    • Footwear
  • Music
  • Celebrity
  • Lifestyle
    • Health
    • Travel
  • BBNaija

© 2021 AmeboUpdate - Website created with ❤ by Dimgba for Brands.

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In